05/11/2021
Update on Anambra governorship election
Di Nigerian Police Force don declare no movement for Anambra state from 12 midnight on Friday.
According to di IG Usman Alkali, restriction of vehicular movement in and out of Anambra State go start from 12 midnight on Friday 5th November, 2021 to midnight of Saturday, 6th November, 2021.
Force tok-tok pesin, Frank Mba for statement say di no movement order na for security to fit tackle jaguda pipo wey get plan to gbege di election on Saturday.