13/08/2025
.Di Nigerian Bar Association (NBA) don condemn Ibom Air and di Airline Operators of Nigeria on top di way dem take handle di incident wey involve Ms Comfort Emmanson - Comfort Bob - for inside one Ibom Air flight on Sunday, 10 August.
NBA describe di airline actions, plus di lifetime flight ban dem sama on Ms. Emmanson, as “reckless,” “unlawful,” and a violation of her right to dignity.
For one statement wey di President of di NBA Afam Osigwe issue, e say di tori na one sided as e only reflect di account of Ibom Air but dem fail to tok how dia security forcefully drag di passenger comot from di airplane and subject her to humiliation.
Di NBA say make di aviation authorities and relevant security agencies conduct thorough inquiry, and sanction evribody wey get hand for di mata.
Di NBA presido add say di NBA ready to provide Ms. Emmanson wit pro bono legal support to ensure say her rights dey protected and say she get compensation for di violations she suffer.
Meanwhile, One of Ms Bob legal representatives don confam to BBC News Pidgin say court don grant her bail and dem dey try perfect di bail paper works, so dat she go fit go house, even as she add say she dey "emotional and e be like she dey scared."
More on dis tori dey here: https://www.bbc.com/pidgin/articles/c4gz526mzv8o