24/04/2026
*YOU THINK SCHOOL HARD? OUTSIDE NA SECONDARY SCHOOL FINAL EXAM EVERY DAY*
For school, if you fail you fit rewrite.
Outside, if you fumble, village people no go even get chance. Sapa go finish you first.
Harsh reality #1: Inside school, your biggest problem is CGPA. Outside, your problem is CGPA, NEPA, landlord, transport, feeding, black tax, and police wahala. All at once.
Harsh reality #2: Lecturer fit give you 40% for attendance. Oga for work go sack you for coming 5 minutes late. No begging.
Harsh reality #3: Your parents still send 10k âmanageâ. After school, youâre the one sending 10k and still apologizing say e small.
Harsh reality #4: âIâm a graduateâ no dey buy fuel. âI sabi do thisâ dey buy fuel, dey pay rent, dey chop.
Harsh reality #5: The same skill youâre saying âI no get time for amâ now, you go pay 200k to learn am later when life don press your neck.
So use this your student era well.
This is the only time you go get 24 hours and small responsibilities.
Read that course like your life depend on it. Because e go.
Learn that digital skill like your childrenâs school fees depend on it. Because e go.
Build that side hustle like your peace of mind depend on it. Because e go.
School na your gym. Outside na championship match.
If you no train now, no cry when life dey give you uppercut.
Your mates don dey prepare.
Some dey do data analysis while still in 300 level. Some dey learn tailoring during holidays. Some dey build LinkedIn while you dey build cruise.
Na the same Nigeria una go graduate enter.
No go outside with empty certificate and empty brain. Come with certificate, skill, sense, and small godfather if you get.
Because outside, âI will call you backâ means âforget itâ.
If this post wake you up, drop âI no dey sleep againâ đ